Saturday, 18 June 2016

Ikorodu Utd don get motor accident

Na proper kasala kon hapun for Friday as Naija Professional Football League club side Ikorodu United bus wey carry players and officials kon get accident wey claim plenty lives inside motor wey dey dia back.
De accident hapun around Ninth Mile area for Enugu State.

Na trailer wey dey come from dia opposite side nearly jam dia bus, if no be say Ikorodu United bus driver dey vigilant well well wey helep am komot dia bus sharperly from de front of de trailer wey save de footballers from death.

But de trailer kon jam de motor wey dey Ikorodu United bus back and kpai all passengers wey dey inside de motor.
Na touch wey de trailer touch Ikorodu United bus bifor hin go hit and kill all people inside de motor wey dey follow Ikorodu United bus for back.

We thank God say no member of de Ikorodu United die for de accident, but na injury plenty of dem bin get as some of dem try jump from de bus.

Harry Balogun wey be team manager for de Oga Boys wey yarn supersport.com don confirm de accident as hin hail dia driver for de fast and quick action wey hin take to save hin team.
Ikorodu United tanda 19th for de NPFL table.

No comments:

Post a Comment